Former Nigeria president Olusegun Obasanjo don tok how di Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) bin reject $750 million offer from business man Aliko Dangote to manage di Port Harcourt and Kaduna refineries for 2007.

For exclusive interview wit Channels Television, Obasanjo tok say NNPCL bin know say dem no get di capacity to manage di national refineries yet dem reject di offer wey Dangote bring.

“Aliko bring one team togeda and dem bin pay $750 million to take part for di Public Private Partnership (PPP) to run di refineries.

“My successor return dia money and I bin tell my successor wetin happun. Im tok say NNPCL say dem bin want di refineries and dem fit run am, I kon tok say, but you know say dem no go fit run am,” Obasanjo tok.

Nigerians bin dey suffer petrol scarcity and increment of pump price anyhow for many years.

Pipo bin blame di NNPCL for di scarcity and high prices sake of di three refineries wey no dey work.

But recently goment tok say two of di refineries, one for Port Harcourt and di oda for Kaduna, don dey work.
Former Nigeria president Olusegun Obasanjo don tok how di Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) bin reject $750 million offer from business man Aliko Dangote to manage di Port Harcourt and Kaduna refineries for 2007. For exclusive interview wit Channels Television, Obasanjo tok say NNPCL bin know say dem no get di capacity to manage di national refineries yet dem reject di offer wey Dangote bring. “Aliko bring one team togeda and dem bin pay $750 million to take part for di Public Private Partnership (PPP) to run di refineries. “My successor return dia money and I bin tell my successor wetin happun. Im tok say NNPCL say dem bin want di refineries and dem fit run am, I kon tok say, but you know say dem no go fit run am,” Obasanjo tok. Nigerians bin dey suffer petrol scarcity and increment of pump price anyhow for many years. Pipo bin blame di NNPCL for di scarcity and high prices sake of di three refineries wey no dey work. But recently goment tok say two of di refineries, one for Port Harcourt and di oda for Kaduna, don dey work.
0 Comments 0 Shares 0 Reviews
Sponsored
Sponsored
Sponsored
Sponsored
Sponsored
Sponsored